fbpx
November 17, 2024

Make Women Be Nigeria next Senate President, Speaker – Oyefusi

call-for-women-senate-presidency

Di deputy governorship candidate of di Labour Party (LP) for Lagos State, Princess Abiodun Oyefusi don call for di zoning of Senate Presidency and Speakership to women.

Oyefusi make di demand while speaking to reporters on di role of women for political participation and di kontri development.

Di 10th National Assembly for Nigeria dey expected to dey inaugurated for di first or second week in June after di swearing-in of President-elect Bola Tinubu.

Oyefusi yarn say if women lead di federal legislature go verify di reality of running an inclusive government.

 

FOR MORE NEWS: Peter Obi deny say hin call 2023 presidential election ‘religious war’

 

On Monday, she yarn say e dey important to uphold di provisions of di national gender policy and to dey intentionally gender inclusive.

Di woman advocate ask political leaders make dem honour di judgment on di implementation of di national gender policy.

The judgement was granted in favour of Nigerian women by Honourable Justice Donatus Okorowo of the Federal High Court.

You fit go read di tori as Oyefusi call for women senate Presidency…READ MORE