fbpx
November 17, 2024

Tinubu dey prepared for di job, envoy don tok

tinubu-dey-prepared-for-di-job-Abioye

Nigerian High Commissioner to di Islamic Republic of Pakistan, Maldives and Afghanistan, Mohammed Abioye, don yarn say di President-elect Asiwaju Bola Tinubu dey well prepared for di job and hin dey up to di task.

However, Abioye yarn say Tinubu need di support of all to take Nigeria to greater heights.

He call on Nigerians, irrespective of political affiliations, say make dem give di incoming administration di maximum support.

Di envoy, during video conference interview with reporters, hail President Muhammadu Buhari for laying solid foundation for Tinubu to build upon.

He express confidence in Tinubu ability to make life abundant for di Nigerian masses. Also, hin tok about how hin make Lagos State di envy of others when hin be governor.

 

 

FOR MORE NEWS: Make Women Be Nigeria next Senate President, Speaker – Oyefusi

 

On hin stewardship for Pakistan, Abioye yarn say Nigeria and Pakistan enjoy very nice relationship diplomatically, politically and economically, and dem dey build on dat one.

According to wetin hin tok, di Nigerian Embassy get some open tok with di Pakistani government on some areas of collaboration to move di present level of trade up.

Hin add say di Areas where Nigeria fit collaborate with Pakistan include education, agriculture, pharmaceutical, security, real estate, information technology and textiles.

Also, hin yarn say about 30 years ago, Pakistani dey always go teach for Nigerian schools. In addition, Pakistan follow get robust textile industry wey Nigeria fit learn from.

You fit go read di tori see as Tinubu dey prepared for di job…READ MORE