fbpx
November 17, 2024

Nigeria dey invest heavily in youths – Buhari

nigeria-invest-heavily-in-youths

President Muhammadu Buhari don yarn say e don tey wey Nigeria dey invest heavily in di youths.

Buhari tok say youths don prove say dem fit drive di change process and contribute positively to di socio-economic growth of dia communities.

Di President make di remarks as hin dey declare open di Commonwealth Youth and Students Summit for Abuja.

Also, Buhari yarn say hin administration don perform well for youth development, ensuring strong platforms through which youths fit hone dia leadership skills.

Represented by Chief of Staff Ibrahim Gambari, he pledge say Nigeria go continuously create an enabling environment for young people to reach dia potential.

 

FOR MORE NEWS: APP don withdraw petition against Tinubu for Presidential Election Tribunal

 

In addition, Buhari express optimism say hin summit go reach actionable policy decisions wey  go enhance di development and productivity of di youth.

Also, di President observe say di young dey lead di way for ICT, Robotics, Artificial Intelligence, E-Commerce and so on

However, di government yarn ay dem dey committed to di actualization of Commonwealth values and believes in di power of di youth to make a difference.

You fit go read di tori as Buhari yarn say Nigeria invest heavily in youths…READ MORE