Tinubu don comot for Nigeria go Europe, hin give reasons for trip
Di President-elect, Bola Tinubu on Wednesday don comot from Nigeria go Europe on working visit.
As hin dey for Europe, Tinubu go finetune di transition plans, programmes, and policy options with some of hin key aides without distractions.
During di visit, di President-elect go engage with investors and other key allies with di goal of marketing investment opportunities for di country and hin administration readiness to enable business-friendly climate through policies and regulations.
FOR MORE NEWS: APP don withdraw petition against Tinubu for Presidential Election Tribunal
A statement by hin Media Aide, Tunde Rahman yarn say dem don already start meetings with multi-sectoral actors for Europe business community including manufacturing, agriculture, tech and energy don line up.
Before hin comot for di country, Tinubu meet with di House of Representatives candidates for Speaker and Deputy Speaker endorsed by hin party, di All Progressives Congress, Hon. Tajudeen Abbas and Hon. Benjamin Kalu, wey dey presented to him by the Joint Task Team of di House.
Also, hin plan to return shortly for preparations towards hin official swearing-in as di 16th President of Nigeria on May 29, 2023.
You fit go read di tori as Tinubu don go europe…READ MORE