fbpx
November 17, 2024

Osun: Adeleke no suppose borrow to pay salaries – Economic expert, Ogunyemi

economist-warn-adeleke-against-borrowing-

An economist at di Obafemi Awolowo University, Ile-Ife, Dr. Tunji Ogunyemi don warn Governor Ademola Adeleke of Osun State against borrowing from banks to pay salaries of di state civil servants.

Ogunyemi yarn make Adeleke pay salaries based on di money wey dey di state coffers and make hin no go banks to borrow money to settle salaries.

Also, Ogunyemi, inside interview on radio wey dey monitore for Osogbo on Friday, yarn say di Osun Inland Revenue Service, OIRS, di state Internal Generation Revenue agency na hin dem suppose use to generate more funds instead of borrowing money to pay salaries.

 

FOR MORE NEWS: Those against Tinubu swearing-in dey ignorant – Elders Forum President, AbdulAziz

 

In addition, hin yarn say dem need to put suspension now on borrowing. Osun must never borrow to pay salaries. Hin tok say make salaries dey paid only with wetin dey ground instead of to dey go bank borrow with a view to paying salaries. As hin dey tok am, hin yarn say make dat kain thing no happen again.

Also, hin advise Adeleke make hin approach hin predecessor, Adegboyega Oyetola to know how he succeed in paying Osun workers for four years without borrowing.

He yarn say Politicking don finish. Di Governor need to approach Oyetola to find out from am how hin take govern Osun State at dat critical period without di state going broke.

You fit go read di tori as Economist warn Adeleke…READ MORE