Police claim say officer wey Seun Kuti slap dey coma – Sowore
Omoyele Sowore, African Action Congress, AAC, presidential candidate for di last election, don reveal say di Lagos State Police Command claim say di police officer wey afrobeat singer, Seun Kuti slap dey inside coma now.
Sowore drop dis update inside tweet on Tuesday.
Remember say Seun bin dey charged with assault on police officer on Monday.
Di offence violate Section 356 of di Criminal Code Act.
Also, di police prosecutor, S. A. Adebese pray say make di court remand di defendant for 21 days.
FOR MORE NEWS: APC don release Tinubu, Shetima pre-inauguration photographs
But di Magistrate Court for Yaba on Tuesday grant am bail and dem tok say make hin produce two sureties wey get landed properties for Lagos State.
Magistrate Adeola Olatunbosun follow order police make dem complete dia investigation within 48 hours.
Sowore on top hin Twitter page write, ”Prosecutors of the @PoliceNG are asking for an ex parte order to detain @realseunkuti for 21 days just to obtain his “statement”.
”Dem claim say di officer wey dey involved for di matter Police dey inside coma” after hin comot for Seun house and finish writing hin report.
You fit go read di tori…READ MORE