fbpx
November 17, 2024

Adjust your lifestyle to current economic realities, Cleric don tell Nigerians

jos-pastor-advise-nigerians

Rev. Tajan Moltok, di Jos Resident Pastor of Shepherd House Assembly international advise Nigerians make dem adjust to di current economic realities,  following di removal of di fuel subsidy.

Di cleric make di call during di Church mid-week evening service in Jos.

He yarn say Nigerians must prioritise dia movements and expenditure as coping mechanisms to reduce hardship.

Also, hin advise di congregants say make dem no live fake lifestyle for society validation. Hin yarn say to be Christlike na di ultimate than to please pipo.

 

FOR MORE NEWS: Why marriages no dey last these days – Apostle Johnson Suleman

 

Moltok yarn say di current economy na period for di congregants to reflect on investment and to have multiple streams of income to handle life challenges. Hin advise dem make dem no use di situation as an excuse to compromise or perpetrate unlawful activities.

He encourage dem say make dem trust God to overcome difficult times.

You fit go read di tori as di Jos resident Pastor advise Nigerians ….READ MORE