fbpx
November 22, 2024

UN announce 12 African Kontries to receive malaria vaccine

un-announce-malaria-vaccine

Di World Health Organisation, WHO, Global Vaccine Alliance (GAVI) and di UN Children’s Fund (UNICEF) don announce say twelve African Komtries go receive di malaria vaccine.

Inside statement issued on Wednesday, di agency reveal say di nations go receive eighteen million doses of di first-ever vaccine against malaria over di next two years.

Also di RTS,S vaccine dey overseen to more than 1.6 million children for Kenya, Ghana and Malawi since four years ago and dem dey  safe and effective.

NAN reports say e result in a considerable reduction in severe malaria and e reduce child deaths.

Di WHO Director-General Tedros Ghebreyesus yarn say malaria remain one of Africa deadliest diseases, wey don kill nearly 500,000 children under the age of five yearly and e account for approximately 96 percent of global malaria deaths in 2021.

 

FOR MORE NEWS: Taraba state Governor don slash state university school fees by 50 percent

 

Ghebreyesus as hin dey tok during hin regular media briefing from Geneva yarn say, with di climate crisis changing weather patterns, mosquitoes wey carry these diseases dey increase with full force and dem dey spread go everywhere

Di initial eighteen million dose allocation go allow nine additional African nations to introduce di vaccine into dia routine immunisation programmes for di first time.

Also, those Kontries include di Democratic Republic of the Congo, Burkina Faso, Niger, Uganda, Benin, Liberia, Burundi, Sierra Leone and Cameroon.

Di first doses dey expected to arrive during di last quarter of dis year, with rollout set to start by early 2024.

You fit go read di tori as UN announce malaria vaccine…READ MORE