Subsidy: Shelve plan of sharing N8000 palliatives – Shehu Sani
A former federal lawmaker wey represent Kaduna Central for di 8th assembly, Shehu Sani, don call on federal government to shelve di plan of sharing N8000 palliatives following the removal of fuel subsidy.
Di former senator yarn say di subsidy regime for di kontri na fraud and a cesspool of corruption.
Also, hin argue say while di present government get di courage to remove subsidy, dem lack clear layout plan on wetin to do.
In addition, Sani yarn say di previous administration embarked on similar project by sharing money with vulnerable Nigerians, but dat on fail, and e make pipo poorer.
FOR MORE NEWS: We no date – Simi don clarify relationship with Falz
Di palliatives [of the previous administration] suppose dey for solving di problem of poverty. And now, di money wey Buhari share end up as something wey make pipo suffer for hardship more.
Speaking further, he contend say if di FG goes ahead with di plan to share di loan, “e go dey ‘suicidal’ and hin tok say difference no dey in borrowing to pay for subsidy. Rather, di thing wey dem suppose do na to use di money support businesses so dat e go grow.
You fit go read di tori as Sani tell FG make dem Shelve plan of sharing N8000 palliatives…READ MORE