FG go construct flyover for Abuja-Lokoja road – Umahi
Minister of Works, David Umahi yarn say di ministry wey dey under hin watch go construct flyover as permanent solution to end di perennial flooding for di Abuja-Lokoja highway.
Di News Agency of Nigeria, NAN, report say di minister tok dis one on Tuesday during hin tour to inspect ongoing construction works for di Abuja-Lokoja road a day after hin inauguration for office.
In addition, di minister, alongside di Governor of Kogi State, Yahaya Bello and some directors for di ministry, visit some work sites for road.
According to di minister, di Abuja-Lokoja road na major gateway wey link di southwest, south-south and southeast regions to di Federal Capital Territory and di northern part of di kontri.
Hin yarn say dem need to prioritize di critical role to di socio-economic life of di kontri.
FOR MORE NEWS: Guber polls: Peter Obi boast say LP go take Imo
However, di minister advise di contractors wey dey handle di road project say make dem use concrete, also hin add say pipo go come review am and dem go and redesign di road contracts.
Also, hin promise to deliver concrete roads across di kontri, hin yarn say those types go dey more durable and e fit last up to 50 years and e dey maintenance free.
You fit go read di tori of di Flyover for Abuja-Lokoja highway…READ MORE