Why I dey bath with blood, 49-year-old man tell Ogun Police
Police don arrest One 49-year-old man, Ganiyu Shina of Oguji Street, Obantoko, for Abeokuta, wey dey bath with blood for community river.
Di Ogun State Police Command don arrest Ganiyu Shina wey dey live for oguji street,Obantoko base on say hin dey bath with blood for one river, wey dey for Kotopo area of Odeda Local Government.
U FIT ALSO READ Two sons of Borno ex-commissioner, don kpai for auto crash
Ganiyu shina tok say no bi hin fault oo say na di institutions wey di herbalist give am na hin him follow.
Na pipol wey bin dey for di community see am wen hin park hin Nissan commercial vehicle near di river, ganiyu con still bring out locally made sponge and one container wey blood dey inside con dey use am dey bath inside di river.
Immediately hin see say pipol dey watch am hin con dey do fast fast to comot for di river but unfortunately pipol for di community pursue am comot from di river con hand am to police pipol for di area.
On interrogation, Ganiyu tok say hin get spiritual problem, and na di herbalist man wey hin go meet instruct am to perform di ritual.bi bathing with blood.
Hin tok say di blood wey pipol see for hin hand wey hin take dey bath so, no bi human blood, say na cow blood.
Meanwhile, di State Commissioner of Police, Lanre Bankole, don tok say make dem carry di remaining blood go laboratory for analysis, to know if say na true hin dey tok.
Di CP also praise di members of di community say dem try well well say dey no do jungle justice to di man. therefore, hin assure dem say dem go properly investigate di matter well well.
To read di full tori CLICKHERE