Apata fire: Makinde sympathize with victims wey di fire affect
Gov. Seyi Makinde of Oyo State don sympathise with traders wey dia property lost inside fire on Thursday for one tanker fire outbreak for Apata area of Ibadan.
Makinde yarn dis one through hin deputy, Chief Adebayo Lawal, who, on Friday evening, visit di venue of where di fire outbreak take happun to assess di level of damage.
U FIT ALSO READ Bandits kill 120-year-old woman and 5 others for Sokoto Bandit don attack
According to News Agency of Nigeria (NAN) dey tok say di fully loaded tanker on Thursday evening, for Apata area of Ibadan, around 6:15 p.m. loose control and exploded as he fall down on di road.di fire destroy many shops and other structures wey dey close to ram.
Hin tok say di governor don assure di victims wey di fire affect say government go support dem, in order to minimise di painful effect wey di incident don cause.
Hin describe di incident as wetin pain am well well but, hin still thank God say no life bin lost for di incident.
Di government of Oyo State under di leadership of Gov. Seyi Makinde don sympathize with all di pipol wey lost property, goods and other Valuable resources of livelihood to di unfortunate incident.
Di governor don caution motorists, particularly drivers to always ensure say dia vehicles dey in good condition bifore dey embark on any journey.
To read di full tori CLICKHERE