Three passengers don kpai, 12 pipol don woundjor for Ondo auto crash
Three passengers don kpai and 12 don woundjor for one auto crash, wey bin happun for Shasha Market, along Akure-Owo highway, on Sunday.
The auto crash bin sele around 5:50 am on Sunday morning.
U FIT ALSO READ Police arrest Six suspected robbers, kidnappers for Delta state
Eye witness tok say di auto crash bin involve one Ash colour Toyota Sienna bus, marked, LND778YG and another Ash colour hummer bus, with registration number, KTN 298 YJ.
Dis crash according to report bin happun base on wrongful overtaking and over speeding.
According to report we hear say di three passengers including di driver wey dey inside di Toyota Sienna na hin kpai change address go yonda.
Di eyewitness tok say ” di driver of di Toyota Sienna attempt to overtake one trailer like dat on a single lane highway bifore hin con go hit di Hummer bus wey dey come from Lagos State.
Ondo State Sector Commander of di Federal Road Safety Corps, (FRSC) Ezekiel SonAllah, confirm say na three pipol kpai and 12 pipol na hin woundjor.
Hin tok say di injured victims bin dey for General Hospital like dis for Akure dey collect treatment while those ones wey kpai don dey for same hospital Mortuary.
To read di full tori CLICKHERE