Withdrawal Limit: Reason why i no dey available to brief house of rep – Godwin Emefiele
Di Central Bank Governor, Godwin Emefiele don refuse again to appear bifore di House of Representatives over cash withdrawal limit policy of di CBN.
Di CBN Governor, inside one letter written by di Deputy Governor, Corporate Services, Edward Adamu, tok say di CBN governor currently don travel go outside di country for official assignment.
U FIT ALSO READ Withdrawal limits go curb politicians, CAN president
Hin tok say di CBN governor Godwin Emefiele go communicate with di House anytime wey hin dey readi.
Hin tok say like dis like dis di governor no dey available to brief di House of Representatives at dat time wey dem tok say dem wan see am, base on say hin get other official assignments to attend to for oversea.
Edward Adamu tell di house say, di governor don ask di house to reschedule anoda date give am base on di inability to honour dia invitation.
Hin tok say di governor regret say hin no show up but hin go contact di House of Representatives as soon as possible wen he return to di countri
To read di full tori CLICKHERE