fbpx
November 15, 2024

FCTA don demolish Durumi IDPs camp over insecurity mata for Abuja

Di Federal Capital Territory Administration (FCTA) on Wednesday don demolished di Durumi Internally Displaced Persons (IDPs) camp.

At di same time dey don demolishe number of shanties. and government tok say di reason why dem do am na base on say dem dey cause security challenges.

U FIT ALSO READ Bayelsa govt don pledge completion of roads

Di Executive Secretary, Federal Capital Development Authority (FCDA), Shehu Ahmad said tok say di IDPs camp one one place wey give room for bad things

Hin tok say dat place suppose bi one place wey pipol dey use for transportation of pipol, goods etc but hin lament say hoodlums don takeover di area .

Hin tok say,“ di kind level of criminality act wey dey happun for dat place no be wetin to write about at all.

” Many pipol for dat area dey constitute nuisances not only to di neighborhood but to di entire city”, na wetin hin tok bi dat.

Ahmad tok say di FCTA go dey continue to sustain dia operation to comot unruly pipol wey dey for di nation’s capital.

Those pipol wey dem arrest with hard drugs and other substances during di raid, dem go hand dem over to the police.

To read di full tori CLICKHERE