Female kidnapper arrested for abducting one small girl for Ogun state
Police for Ogun State don arrest one 27-year-lady, wey her name bi Mariam Ayila for kidnapping one 13-year-old girl, Sofiat Yusau.
Dem bin arrest di suspect base on di report wey dey lodge for Agbara divisional headquarters by one Ismail Yusau.
U FIT ALSO READ FCTA don demolish Durumi IDPs camp over insecurity mata for Abuja
Di police spokespersin for Ogun, Abimbola Oyeyemi, tok say di complainant tok say hin send hin daughter on an errand to Agbara market, suddenly na so hin receive one strange call a few hours later from an unknown persin say dey don kidnap hin daughter.
Di complainant tok say di abductor dey demand for di sum of N250,000 as ransom to free hin daughter.
According to Oyeyemi, the DPO of Agbara Division, CSP Abiodun Salau, don mobilize detectives, wey bin embarked on one technical and intelligence-based investigation.
Hin tok say,“ Dia efforts yield positive result when dey trace di suspect dey later find out say her hideout ma for Atan-Ota,
According to him, dey don handover di suspect to one Anti-kidnapping Unit of di state CIID for further investigation and prosecution on the directive of Commissioner of Police Lanre Bankole.
To read di full tori CLICKHERE