fbpx
November 22, 2024

1 persin don kpai, as others woundjor as 40-ft container fall ontop 3 cars for Lagos

Bad moments happun, yesterday for Cele bus stop along Apapa-Oshodi expressway, after two containers fall from truck con land ontop three vehicles.

One of di drivers of di commercial bus with plate number AKD 489 XZ, bin dey trapped inside, as di incident happun and instantly hin don kpai.

U FIT ALSO READ Fuel scarcity: Depots don dry, Nigerians dey face sad Christmas

But hin passengers and other occupants of di two other vehicles, one Toyota Rav 4 with plate number AAA 353 FH and one Highlander SUV with number plate AGL 366 FP, escape deatj.

According to tori pipol, di truck, bin carry two containers for back which dem no tightening well to di truck bodi, along di Apapa axis. suddenly ka so hin get brake failure.

Some of di passengers, wey manage to escape from the bus, sustaine very big injuries base on dis alignment.

One of dem, na woman with her three-year-old pikin wey fall in di process of say she dey try ensure say nothing must happun to her pikin as she hurry carry her pikin to where dey safe.

One Mr Daramola Oluwaseyi, tok,say ” di major cause of incident na base on di construction work wey dey happun for di expressway. as di construction company don block everywhere.

At di time of writing this report, some rescue teams of Police, Federal Road Safety Corps and the Nigeria Security and Civil Defense Corps all of dem dey di area to rescue pipol.

To read di full tori CLICKHERE