2023: Tinubu dey distance himself now from APC failures – Atiku
Di Peoples Democratic Party, PDP, presidential candidate, Atiku Abubakar don yarn say hin counterpart from di All Progressives Congress, APC, Bola Tinubu dey try distance himself from di APC failures for President Muhammadu Buhari government.
Atiku yarn say di criticism wey Tinubu dey tok against Buhari government na attempt to distance himself from di failure of di current government.
Di former Vice President, wey tok this matter through hin Special Assistant on Public Communication, Phrank Shaibu, bin dey react to Tinubu remark as hin tok say “dem move di exchange rate from N200 to N800.”
As Tinubu bin dey tok during hin campaign rally for Abeokuta, Ogun State, Tinubu yarn say, it to say dem quickly arrest di situation that time, Nigeria no go dey where e dey now.
FOR MORE NEWS: “Peter Obi go fail you, hin deny Jesus 3 times” – Tinubu dey tell Anambra Citizens
Atiku lament say Tinubu dey distance himself from di failures of APC wey hin defend with everything wey hin get during di year 2015.
A statement by Shaibu yarn say, “Tinubu dey criticise Buhari, hin dey try to detangle himself from di failures of APC wey hin defend for di last eight years. Also, hin advise Nigerians make dem no dey deceived by Tinubu trick, especially now wey hin dey pose to be on di side of di masses.
In addition, hin tok say e dey funny as Tinubu dey throw di President under bus for hin failed and desperate quest for power. This na person wey don proudly hold di position of national leader of di APC for di last eight years.
You fit go read di full tori…READ MORE