fbpx
September 29, 2024

Naira Redesign: Ganduje don expose Emefiele alleged plan to APC chances for elections

redesign-notes-ganduje-expose-emefiele-plan-for-APC-elections

Di Governor of Kano State Ganduje on Friday yarn say di naira redesign no be di agenda of di All Progressive Congress, APC, but na calculated plan by Central Bank Governor, Goodwin Emefiele and some other pipo wey surround President Muhammadu Buhari.

Hin make di allegations during interview for di BBC Hausa radio service.

As di matter be, di currency swap don put over two hundred million Nigerians under pressure. Infact, pipo for some part of di country southwest don dey protest because of di lack of physical cash flow.

FOR MORE NEWS: New naira notes: Election riggers dey push CBN for extension — Atiku

Ganduje yarn say by next week if issues regarding di currency issues and Redesign notes neva dey resolved following di meeting between President Muhammadu Buhari and state governors, di governors go take step to make sure say di plan by di Central Bank Governor Emefiele and a few other pipo no go put di country inside crisis, even as election dey near.

Speaking with newsmen after di meeting for Abuja, Ganduje yarn say di CBN Governor, Emefiele bin deceive President Muhammadu Buhari into redesigning di naira because hin fail to make di APC primaries wey bring Bola Ahmed Tinubu and Senator Kashim Shettima as di Presidential and vice presidential candidates.

Also speaking di Kaduna State Governor, Malam Nasiru El-Rufai yarn for meeting with di president centres on di lack of flow of cash across di country.

According to Governor Elrufai, dem receive information say  CBN so far don mop over N2trn from circulation but only print about N 300 billion. Di wahala now be say this amount no dey enough to go round over two hundred million pipo wey dey look for cash.

Also, di President ask for time to have a discussion with di Central Bank and dem dey wait for di aftermath of that meeting.

However, di Kaduna State Governor, however, give warning say di issue wey dey ground fit throw di country inside trouble.

You fit go read di full tori…

Naira Redesign: Ganduje exposes Emefiele’s alleged plan to ruin APC’s chances at elections