2023: Election results go shock El-Rufai – Babachir Lawal
A former Secretary to di Government of di Federation (SGF), Babachir Lawal, don yarn say di presidential candidate of di Labour Party (LP), Peter Obi dey gain support for “unexpected areas”, hin tell El-Rufai say di election results go shock am.
Lawal drop this update as hin dey tok for Channels Television on Friday during intervew.
He yarn say di Labour Party popularity wey dey grow go shock pipo wey dey bad-mouth am.
FOR MORE NEWS: “Peter Obi Na Nollywood actor, presidential election dey between APC, PDP” – El-Rufai
Reacting to comments by Kaduna State Governor, Nasir El-Rufai, hin say Obi no fit win, but di former SGF Babachir yarn say di election results go shock am.
“Every Nigerian dey determined to contribute to di forthcoming election, including di pipo wey Nasir el-Rufai claim say dem no plenty. He yarn say northern Christians no many.
According to di former SGF, hin wan wait for February 25 and Nasir El-Rufai go see di shock of hin life.
You fit go read di full tori…READ MORE