fbpx
September 29, 2024

Viral News: Pastor dey pray make miracle money enter members bank accounts during crusade

pastor-pray-for-miracle-money-for-members

One Nigerian pastor don cause mixed reactions as hin dey pray make miracle money enter di account of hin church members during crusade. Di video wey dey make rounds on social media capture di moment wey church members raise dia phones for air to receive miracle money.

During di crusade, di pastor encourage hin congregation say make dem get have faith in am to get wealth because ‘money na spiritual thing.’

“You told me that the words of my mouth will not fall to the ground; you told me that whoever I bless shall be blessed. I stand in my office as God’s servant, lift up those phones, I command money to enter your account,”  Na wetin di pastor tok be that.

However, di video don stir reactions from netizens wey feel say di members dey gullible as dem dey expect miracle money from di pastor.

FOR MORE NEWS: Grammy: I no take am for granted, Tems dey appreciate fans for dia support

One of di social media user wey react to di video yarn say, Pastor wey suppose pray make money enter hin own account so that hin go transfer am to di pipo by himself. But because hin  know say di transfer by prayers no dey work, he kon invite dem for a special programme so that hin go collect offering from them while dem expect Miracle tranfer.
Yahoo Pastor 1000 – Gullible Christians o.”

Another user add say, “Religion na di drug of the masses. ~ Karl Marx.

Also, hin yarn say for hin language, na drug wey dey reduce di capabilities and capacities of di neurological functioning of humans…

Religion dey created to make foolish pipo feel better about dia ignorance…E go make you see foolishness as right, and rightness being foolish…

Even when I neva  reach di age of reasoning, I no believe or fall for this kain nonsense…” Na wetin di other social media user tok be that.

You fit go read di full tori, watch di video…READ MORE