fbpx
September 29, 2024

2023: Peter Obi dey call for prayers as presidential election draw near

peter-obi-prayers-for-election

Di presidential candidate of di Labour Party, Mr Peter Obi, don call on church for prayers on di emergence of President wey go use public funds for di public good.

Obi drop this update for di 17th Biennial Conference of di Pentecostal Fellowship of Nigeria (PFN). Also, dem hold di conference for Yenagoa, Bayelsa State capital.

He yarn say Nigeria don go through a lot, and he add say na prayers of di Church fit keep di country together.

According to Peter Obi: hin ask for prayers from Nigerians and he ask for prayer points too.

In addition, hin tok say hin prayer points as we go for election, na make God Almighty ensure say Nigeria elect somebody with character. Also, e pray for somebody wey dey competent, and somebody wey go respect our religious rights.

FOR MORE NEWS: Obidient don tattoo Peter Obi for hin chest, netizens dey mock am

Hin pray say make God continue to touch politicians so that dem go fit use public money for public good.

Also, Peter Obi add say without prayers Nigeria no go dey where e dey today, Nigeria don go through wetin other country never go through and e still dey stand, and only Nigerians prayers fit save us.

“Please remember to put your country for your prayers,” Na wetin hin tok be that.

Di PFN 17th National Biennial Conference bin get for dia attendance one renown clergymen like Pastor Enoch Adeboye and Bishop David Oyedepo.

Other Pastors wey dey there na David Ibiyeomie, Bishop Mike Okonkwo, Rev. (Dr) Felix Omobude and di National President of PFN, Bishop Francis Wale-Oke.

You fit go read di full tori…READ MORE