fbpx
September 29, 2024

Naira redesign: CBN policy dey disastrous – Catholic Bishops to Federal Government

Catholic-Bishops-to-Federal-Government

Most Rev. Lucius Ugorji, President Catholic Bishops Conference of Nigeria (CBCN), on Sunday, charge di Federal Government. Dem yarn say make FG review di new cash policy to ease di hardships wey e dey cause Nigerians.

Ugorji make di appeal for di opening of di 2023 First Plenary of CBCN. Dem hold di meeting for di Catholic Secretariat for Abuja.

Di theme of di meeting na: ‘Citizens’ participation in good governance in Nigeria’.

While catholic bishops express dia concerns to federal government, dem say di policy don cause frustration among Nigerians.

As di value of Naira continues to decline, di price of necessary commodities, including food items, don continue to increase. This matter don cause serious effects on di lives and livelihoods of pipo.

FOR MORE NEWS: Lagos government don shut down Chrisland school over Whitney Adeniran death

According to Ugorji, di disastrous implementation of di Central Bank of Nigeria (CBN) cash swap policy don add to di anger, and frustration of di masses.

Also, di CBCN president advise politicians make dem no dey stop engage in name-calling, malice, buying and selling of votes, threats, intimidation and violence ahead of di general elections.

Ugorji yarn say instead of putting energy on negativity, make di pipo wey dey aspire for political offices concentrate on marketing dia manifestoes.

Also, hin advise di dependent National Electoral Commission (INEC) and security agencies make dem ensure say di election process dey beyond reproach.

He yarn say di political contests no supposed dey sensed as “do or die” affair.

You fit go read di full tori…READ MORE