fbpx
September 29, 2024

Police don react to trending video of Abuja-based pastor wey carry AK-47 rifle dey preach for church

police-react-to-pastor-holding-ak-47-riffle

Pastor Uche Aigbe, di presiding pastor of House on di Rock church, Abuja, dey captured as hin carry AK-47 rifle as hin dey preach for di church on Sunday.

Police reacts

Di viral clip cause mixed reactions after person post am for  Twitter. Plenty pipo yarn say why di pastor for carry AK-47 dey preach, Police sef don react to di matter. Dem criticise clergyman as hin carry di weapon, and dem yarn say e dey illegal.

FOR MORE NEWS: “I don blow” – Portable dey happy as Tiwa Savage reply hin DM

However, Some members of di church come out to defend di clergyman. Also, dem explain say hin hold di ifle for illustration purposes only. In addition, dem say di gun no dey loaded with bullets and nobody for di church bin dey fear.

Reacting to di controversial video, CSP Adejobi yarn say hin don forward am to di Commissioner of Police for FCT, and they go start investigation on di incident.

He add say di clergyman go get case to answer if e dey found guilty as civilians no dey allowed to carry arms.

“But if its true, the pastor will have a case to answer. AK47??. It falls under prohibited Firearms in Nigeria, and no one bears it except an officer of the law, and not all of them have the right, selected sec operatives, but no individual has the right to bear it,” Na wetin hin tweet be that.

You fit goi see di full tori…READ MORE