fbpx
September 29, 2024

South East go vote for Tinubu because of Second Niger Bridge – Governor Umahi

governor-umahi-say-igbos-go-vote-for-tinubu

Governor Dave Umahi of Ebonyi state, don yarn say Igbos go vote for di Tinubu, di All Progressives Congress at Federal and State levels as a way of appreciating President Muhammadu Buhari.

Governor Umahi yarn say vote from di South East for APC presidential candidate, Bola Ahmed Tinubu go plenty because of di Second Niger Bridge wey Buhari construct.

Umahi make di statement on Tuesday while hin dey address supporters for di APC South-East grand finale rally for Owerri, Imo state.

Di Imo State Governor, Hope Uzodimma, wey follow dey di rally assured di party say hin state go deliver for APC during di February 25 presidential election.

FOR MORE NEWS: “2023: Crisis go happen if Peter Obi or Tinubu lose” – Primate Ayodele dey warn

Also speaking, di Governor of Lagos State, Babajide Sanwo-Olu yarn say di Igbo pipo for di south-west, particularly di pipo wey dey live for hin state go stand with Tinubu and dem dey prepare to vote for am.

On his part, Tinubu promise say if hin dey elected, hin administration go continue di developmental programmes of di President.

According to Tinubu; “PDP thief Nigeria treasury. President Buhari eight years na retooling process. Di PDP na liars. Also dem go continue with developmental programmes of the APC, e no go stop.

“Imo na di destination for tourism, we go add value to real estate for Imo State, invest in education, build and reconstruct di roads for Imo. No more issue of ASUU strike. We go dey prudent and manage revenue generation capacity, we go bring peace, we go work with di state to ensure security.”

You fit go read di full tori…READ MORE