fbpx
September 30, 2024

E no dey proper – Wike dey against Buhari decision of lifting restriction on old N200 notes

wike-dey-against-buhari-decision

Governor Nyesom Wike of Rivers State dey against President Muhammadu Buhari decision to ban di use of old N500 and N1000 notes, hin say e no make sense at all.

Wike, wey expressed sadness over Buhari declaration, yarn say e no dey proper, he say e dey against Buhari decision.

Di Central Bank of Nigeria don extend di deadline for di swap of N200, N500, and N1,000 from January 31 to February 10.

Also, di Supreme Court don order di Federal Government and di CBN make dem discontinue with di deadline pending di determination of motion on notice in respect of di issue on February 22.

FOR MORE NEWS: 2023 poll: APC El-Rufai, Ganduje, Badaru group dey against Buhari

But, Buhari direct di apex bank make dem recirculate only di old N200 notes with di new ones.

However, Wike yarn say di President declaration, despite di Supreme Court ruling, no dey proper.

For inside media chat, di governor say: “Di highest court of di land don make hin pronouncement. Supreme Court don tok say make dem no do anything wey go affect di use of di old naira note.

“I feel say di President declaration no be di proper thing and I no dey happy.” Na wetin Wike tok be that.

“This one tells us how we no dey respect or obey di rule of law. At this level, di advisers to di President suppose say, ‘This issue dey subject to litigation and any step you take go one way or di other affect di Supreme Court’s (stance)’.” Na Wike still tok this one.

You fit go read di full tori…READ MORE