fbpx
September 30, 2024

Just In: Unrest for Mile 12, Ketu over Naira scarcity

naira-scarcity-unrest-for-ketu

News all over social media show say na serious trouble and unrest dey happen over Naira scarcity for di Mile 12, Ketu axis of Lagos State.

Pipo dey vex over Naira scarcity wey dey happen, some youth don enter street cause unrest.

According to reports, di riot dey happen for di Mile 12 to Ketu axis, as vehicles dey turn back from Ojota and Ikorodu. Also, pipo wey dey around that area dey strictly advised to either stay safe or find alternative routes, and make dem completely avoid those areas.

Some Twitter users don send ahead warnings to others make dem avoid those routes. See Tweets below;

Osinachi @OsinachiNuel – Unrest in Mile 12 underbridge to Ketu axis. Vehicles dey turn back from Ojota and from Ikorodu. Let’s be safe and watchful out there.

chukason –  Avoid ketu mile 12 for now @Policel”’ pis come 0000 we are running. Na hide we dey hide now 00000 its serious sh ting on going but I guess its the police that’s shooting trying to control the situation.  All cars are revising some forget motor run. Tyres are already burning on the major roads.

@destinyisaac500 – There’s Riot in Mile 12 to ketu this morning

You fit go see di full gist…READ MORE