fbpx
September 30, 2024

Yahoo boy under arrest for defrauding hin American wife of $200K, other valuables

yahoo-boy-defraud-american-wife

One yahoo boy dey under arrest by di police after he allegedly defraud hin American wife, Nicole Kieruff Sayers of her $200K and other valuables.

Yahoo boy arrested for defrauding his American wife of $200K, other valuables

Di yahoo boy wey dey identified as Chidozie Kingsley Nwachi bin do false marriage with hin American wife.

Also di American wife call on di Operatives of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) make dem arrest her husband after she allege say di suspect lure her into fake marriage and hin defraud her of her savings and other valuables.

FOR MORE NEWS: Just In: Unrest for Mile 12, Ketu over Naira scarcity

“I was accustomed to transferring money to him and further felt I had no choice since I had just married him, even though I did not feel confident in my choice to have married him,” Na wetin di Oyibo wife tok be that.

According to reports, di Yahoo boy try to defraud hin wife with fake contract by di Federal Ministry of Works and Housing, Abuja, and hin make hin wife finance di execution of the contract until di wife contact di Ministry. Na that moment she discover say na fake contract.

Di Items wey dem recover from di suspect na two cars: Toyota Venza and Lexus ES300, expensive wristwatches. Also, dem recover two Apple iPhones, two iPhone laptops, an international passport, and multiple ATM cards.

In addition, dem recover $2204 from di yahoo boy. This na all di things wey EFCC tok inside statement on Thursday.

You fit go read di full gist…READ MORE