“I don remove my hands from anything wey go lead to wedding” – Alex Ekubo don drop update after messy split from ex-fiance, Fancy
Nollywood actor, Alex Ekubo, still dey deal with di aftermath of hin messy break-up from hin American ex-fiance Fancy Acholonu wey log out of dia wedding.
Di actor wey look like person wey dey enjoy di single life don yarn say he no hope to settle down soon, e be like say di messy break-up don teach Alex Ekubo lesson .
Taking to his Instagram story, Alex Ekubo as hin dey respond to one female fan, wey dey crush on am, yarn say he no wan tie di knot anytime soon.
FOR MORE NEWS: Tonto vs Churchill: Tonto Dikeh continue to drag Olakunle Churchill for denying dia son access to travel overseas
Di female fan share photo of di handsome actor as she reveal say preparations for dia wedding dey underworks. In addition, she yarn say di only thing wey dey stop dem na scarcity of new naira notes.
“Am planning our wedding babes, make all this scarcity of money go fess so that I will marry you properly”. Na wetin di female fan write be that.
Alex Ekubo no waste time reply as hin tok say hin no dey interested in anything wedding.
“Me wey don log out from anything wey go lead to wedding”. Na wetin hin tok be that.