Afenifere youths don promise Peter Obi five million votes
Di Afenifere National Youths Council don vow to support di presidential candidate of Labour Party, Peter Obi, to become di President for di February 25 election.
Na di National President of the council, Eniola Ojajuni, na hin tok this one on Sunday for Lagos.
Ojajuni yarn say Obi get support of di group because of hin records while hin be governor of Anambra State.
During di meeting, hin tok say dem endorse di candidate of di LP, Obi officially as di sole candidate for di Southwest youth wing. Also, hin mention say e take dem almost three months to reach di conclusions amongst 147 youth groups for Yoruba land, and today, dem don officially announce Obi and hin running mate, Ahmed Datti, as dia sole candidate for di presidential election on Saturday.
FOR MORE NEWS: Angry Nigerians don scatter POS vendor workplace over N4K charges on N10K cash withdrawal
According to am, before dem endorse am, Obi assure dem say di first thing wey hin go do na to restructure di country.”
Also, dem believe say di election go hold, and e go be free and fair and di Afenifere youths for di SW dey ready to vote Peter obi. Dia target na to give am five million votes.”
Hin beg Yoruba residents across di country make dem elect Obi, and dem mention say time don reach for South-East to become di president.
You fit go read di full tori…READ MORE