fbpx
November 16, 2024

Naira crisis: APC leaders dey eye sympathy votes for Tinubu

APC-go-get-sympathy-votes Tinubu

Di presidential candidate of di All Progressives Congress, Asiwaju Bola Tinubu, fit end up as di biggest beneficiary of di naira notes change by di Central Bank of Nigeria, according to hin campaigners. Some chieftains of di APC don yarn say Tinubu go get sympathy votes for di forthcoming presidential election, as e dey alleged say di CBN policy target na him.

One of Tinubu loyalists yarn say APC candidate don win di heart of di masses. This na because dem openly oppose di Federal Government actions and inaction wey cause hardships for di pipo.

From Thursday report, during di APC presidential campaign rally wey dem hold for MKO Abiola Stadium, Kuto, Abeokuta, Ogun State, on January 26, Tinubu allege say di crises over Premium Motor Spirit (petrol) scarcity and naira redesign by the CBN na part of di plan to spoil di chance victory for di poll.

 

FOR MORE NEWS: Afenifere youths don promise Peter Obi five million votes

One chieftain of di APC and close associate of Tinubu, Senator Adesoji Akanbi, yarn say that although other political parties and dia candidates follow need cash to prosecute dia campaigns and di matter follow affect dem, however, di ruling party candidate fit get swing votes.

Also, Akanbi yarn say di policy fit kon favour Asiwaju wey dem dey target. Hin still yarn say plenty pipo dey realise say di policy na because of am, and APC Presidential Candidate Tinubu fit get sympathy votes.

According to di APC chieftain, Tinubu victory dey sure. Di evidence na di large crowds for di recent presidential campaign rallies upon di cash scarcity wey dey frustrate di masses.

You fit go read di full tori…READ MORE
.