fbpx
November 16, 2024

Nigeria presidential election: TY Danjuma, Christian elders don endorse Peter Obi

National Christian Elders Forum, NCEF, don endorse di candidate of di Labour Party, LP, Peter Obi. Dem wan support am to win Nigeria presidential election.

Di group of Christian elder statesmen across di country, including former Army chief, retired General T. Y. Danjuma tok am for announcement on Tuesday.

Also, di eminent citizens advice security agencies make dem no take di reports say some regions dey prepare to unleash violence lightly.

Aside that matter, di NCEF call on Nigerians make dem vote candidates based on capacity, ability, integrity, and good health. On top that matter, dem yarn say “a sick country need healthy leaders”.

Christian elders wey endorse Obi title di statement, “Resolutions towards 2023 elections: Think new”. Na Forum Chairman, Dr. Samuel Gani and di Secretary, Pastor Bosun Emmanuel na hin sign am.

Di body tok about di need to make sure say democracy survive. Things like corruption, incompetency, lawlessness, and impunity for di past 24 years go stop.

FOR MORE NEWS: Fraudster don enter prison because hin impersonate Nollywood actor, Bolanle Ninalowo

According to di leaders, National Christian Elders Forum dey endorse Mr. Peter Obi of di Labour Party as di Presidential candidate wey dem go vote for”.

Also, di leaders stresse say Nigeria need new leaders, new methods, new policies, new parties, and dem hail di Federal Government for di steps wey dem take to stop vote-buying.

Although di policy of currency change don bring some inconvenience to citizens, di leaders forum confirm am say pipo go appreciate di long-term benefit.

Also, di members na Dr. Ayo Abifarin, Gen. Zamani Lekwot (retd), Hon. Justice James Ogebe (retd), Elder Moses Ihonde, Dr. Saleh Hussaini, Vice Chairman (North), Elder Shyngle Wigwe, Vice Chairman (South).

You fit go read di full tori…READ MORE