fbpx
November 16, 2024

Nyesom Wike dey plan to comot for Nigeria – Eze don reply PDP on Amaechi-Atiku link

nyesom-wike-eze-reply-on-amaechi

All Progressives Congress, APC, chieftain, Chukwuemeka Eze don fault Governor Nyesom Wike camp over claim against Rotimi Amaechi ahead of di presidential election.

Eze yarn say di accusation about di former Minister of Transport association with di Peoples Democratic Party, PDP, candidate Atiku Abubakar na lie.

Di Rivers PDP Campaign Council, through di spokesperson, Ogbonna Nwuke, claim say Amaechi na member of di“wicked cabal”. According to am, na dem dey punish Nigerians with fuel and naira scarcity.

Nwuke claim say Amaechi hold meetings with Atiku and others to starve di masses of cash in di name of politics.

Although for inside di statement on Tuesday, Eze yarn say dem no fit catch di former Rivers helmsman inside di web of political cowardice like Governor Wike.

Also, di politician yarn say Wike dey play di ostrich. This na so that hin go fit escape blame for di failure of hin administration”.

Eze tok about di time wey na taboo to be associate with General Muhammadu Buhari”, but Amaechi bin support am and serve as campaign Director General during di year 2015 and 2019.

FOR MORE NEWS: Nigeria presidential election: TY Danjuma, Christian elders don endorse Peter Obi

Hin dare Nwuke and “hin paymaster make dem provide Nigerians with details” of di role wey Amaechi play regarding di fuel crisis and cash crunch.

Although di APC member maintain say validity no dey for di Rivers PDP council official’s “irresponsible assertion”.

Eze yarn say di statement wey hin make dey good to impress Governor Wike wey don instruct hin likes make dem drag Amaechi enter dia disastrous political journey.

You fit go read di full tori…READ MORE