fbpx
November 16, 2024

Presidential election: Four popular pastors don announce dia stand as Adeboye, Oyedepo, and others still dey quiet

popular-pastors-still-quiet

Twenty-four hours to di Presidential election, some popular pastors and prophets for Nigeria still dey quiet

Report yarn say a total of 93.5 million Nigerians wey register to vote for di coming election dey expected to choose from 18 candidates on Saturday, February 25, 2023, according to di Independent National Electoral Commission, INEC.

Di major contenders for di much-awaited election na di All Progressives Congress, APC, candidate, Bola Tinubu, Peoples Democratic Party, PDP, candidate, Atiku Abunakar and the Labour Party candidate, Peter Obi.

FOR MORE NEWS: “That sh!t doesn’t work” – Lady don reveal why she stop to dey pray and go church

Although di Christian Association of Nigeria, CAN, don tok about dia choice of party candidates and dia running mates, di body no fit unanimously endorse candidate.

Remember say Christian body don kicked against di decision of ruling party to field a Muslim-Muslim ticket for di 2023 poll, dem lament about how di party neglect di Northern Christians.

Meanwhile, some popular Nigerian pastors, wey prophesy about President Muhammadu Buhari and Yemi Osinbajo victory in 2015 and 2019, still dey quiet about who go be Nigeria next president.

Remember say in 2015, Pastor Tunde Bakare, Rev. Fr. Ejike Mbaka and Pastor Sunday Adelaja bin support di candidacy of President Muhammadu Buhari and Prof Yemi Osinbajo.

You fit go read di full tori…READ MORE