Labour Party dey vex as INEC omit di party logo on Lagos ballot papers
Di Labour Party, LP, don slam di Independent National Electoral Commission, INEC, as dem omit di party logo for Lagos State ballot papers for di Saturdy election.
Remember say INEC had on Wednesday begin take delivery of sensitive materials for di Presidential and National Assembly Elections wey dey planned for Saturday, February 25.
LP Chairman for di State, Dayo Ekong, wey criticize di exclusion of di party Logo on Senatorial and House of Representatives ballot papers inside statement on Thursday, call on INEC make dem correct di mistakes or reschedule di National Assembly election.
As Nigerians dey prepare to go polls to vote for new president and members of di Senate and House of Representatives on Saturday, di LP don fault INEC as dem omit di Labour party logo for on top Lagos ballot papers.
FOR MORE NEWS: Presidential election: Four popular pastors don announce dia stand as Adeboye, Oyedepo, and others still dey quiet
Also she yarn say na di executive members find out for Lagos this morning during di routine inspection of election materials. Na during di inspection dem discovered sa L P no dey listed for di election for di Senate and House of Representatives. This one no dey unacceptable and a wicked way of disenfranchising Lagos State electorates.
She tok say dem no go accept am and dem believe say INEC no make mistake but na deliberate, malicious and intentional act to disenfranchise dia supporters from exercising dia civic rights.
You fit go read di full tori…READ MORE