Polls: Be peaceful- Biden dey advise Nigerians
Di United States President, Joe Biden, on Thursday, advise Nigerians make dem dey patient and peaceful while election officers count dia votes on election day.
For inside statement by di United States Diplomatic Mission to Nigeria, Biden commend political parties and presidential candidates for signing di peace accord ahead of di Saturday, February 25, elections.
Biden advise Nigerians and voters make dem come out on election day to exercise dia fundamental freedom and make dia voices dey heard.
Di statement quote di US President like this, “I commend yesterday’s peace accord in Nigeria, signed by the political parties and candidates running in Nigeria’s presidential election on February 25.
Still inside di statement, Biden yarn say as dem don sign this pledge, di parties and candidates don commit to accept di results of di election, by di time wey di Independent National Electoral Commission go announce am, and to support peaceful transition of power.
Also, hin yarn say elections na fundamental part of a functioning democracy, and all Nigerians deserve this chance to choose dia future — freely and fairly. While di United States does no support any single candidate or party, dem strongly support peaceful and transparent process wey reflects di will of di people of Nigeria.
You fit go read di full tori…READ MORE