Nigerians Decide 2023: D-Day don dey here
Today, February 25, Nigerians are dey for polls to exercise dia electoral rights and to decide 2023. Dem dey voting to elect new President of di Federal Republic of Nigeria, as well as senators and members of di House of Representatives wey go constitute di 10th National Assembly and pilot di affairs of di country for di next four years.
Also, befor now, di road to 2023 general elections be like say e long.
Along the way, some new historic developments show face, such as Electoral Act 2022, di massive registration for Permanent Voter Cards (PVC) and INEC seismic switch to technology-driven elections using di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS).
This year, di stakes dey higher than any other polls for recent history. Also,di record number of registered voters of 93.5 million, di dominant demographics of 48 million youths, di intensity of di electioneering campaign and di political fever wey grip di Nigerian populace na indications say di 2023 general election na great importance to Nigerians.
FOR MORE NEWS: “Una be one of di problems of this country” -Tacha dey tell pipo wey no plan to vote for di upcoming 2023 presidential election.
Di reasons no dey far-fetched. Also, di past eight years na very tough journey for Nigerians. Citizens bear di scars of two recessions, worsening insecurity, religious intolerance, ethnic jingoism and lack of good governance, among other realities wey dey choke pipo. Time don reach for Nigerians to decide 2023, di D-DAY don reach.
Although di unity of di country dey fractured, with di socio-political landscape wey dey divided along several faultlines. As well, everything don worse, unemployment dey di highest. Just like that, di country, enter abyss of poverty whereby 133 million Nigerians dey live in poverty. All these things wey dey happen don give di country badge and title of di poverty capital of di world.
These tribulations don make plenty Nigerians japa, dem don comot from dia fatherland to other countries in search of greener pastures.
Also, di migration syndrome (wey dem dey call Japa) bin start some few years back and e reach hin last year.
Na di biggest brain drain wey don hit di country for living memory. Nigeria don lose a record number of medical professionals and an uncountable population of IT specialists.
You fit go read di full tori…READ MORE