Popular Okada rider, Donatus Mathew, don win House of Representatives seat with Labour Party
Di Independent National Electoral Commission, INEC, don announce Labour Party (LP) candidate, Donatus Mathew, winner of di Kaura Constituency, Kaduna for di Federal House of Representatives.
Donatus Matthew, wey be Okada rider na di first LP candidate to win a legislative seat for di 2023 House of Representatives election.
Also, di returning officer, Prof. Elijah Ella yarn say hin poll a total of 10,508 to defeat di active member and Peoples Democratic Party (PDP), member, Hon. Gideon Lucas Gwani wey come second with 10,297 votes.
Prof. Ella yarn say di candidate of All Progressive Congress (APC) trail with 9,919 votes, while that of di New Nigerian People Party (NNPP), secure 5,354 votes to come third and fourth respectively.
As dem follow newsmen tok shortly after dem declare am winner of di poll, di member-elect, Mathew, thank di electorate for di confidence wey hin give am to represent them for di Green Chamber.
FOR MORE NEWS: Jandor visit di woman wey thugs brutalize during election for Lagos, he blame APC
However, hin beg for support and cooperation from di people, while hin pledge to carry everyone along to achieve di desired success.
E dey gathered say hin start to ride okada after things kon get as e be for am following hin time as a Councilor.
Also, di incumbent legislator wey be di Minority Whip for di House of Representatives, Mr. Gideon Lucas Gwani, congratulate di member-elect and hin wish am well.
He advise hin supporters make dem remain calm and accept the will of di electorate, even as he yarn say God gives and takes power to and from anybody wey jhin please at di appropriate time.
You fit go read di full tori…READ MORE