JUST IN: Atiku, Obi don approach court, dem demand election materials inspection
Di Peoples Democratic Party and di Labour Party presidential candidates, Atiku Abubakar and Peter Obi respectively don approach di Presidential Election Court. Dem wan ask for permission for di inspection of election materials wey dem use for last Saturday poll.
According to report, Atiku and Obi no gree accept di defeat for di February 25 presidential election, hin vow to approach court recover dia mandate.
Di two candidates overlook di gesture of conciliation wey di President-elect, Bola Tinubu make for hin acceptance speech. Dis na after dem declare am di winner of di poll on Wednesday. For di speech, Tinubu bin ask dem say make dem support am for di task of building di nation.
Atiku and Obi follow tok for separate news conferences for Abuja on Thursday.
FOR MORE NEWS: 2023 election results: PDP dey ready to form alliance with Peter Obi – Atiku
To walk dia tok, di two presidential candidates ask PEC for Abuja make dem allow dem inspect materials wey dem use for di February 25 election.
Also, dia request dey contained inside two ex-parte motions wey dem file for PEC secretariat. Dis one happen for di Court of Appeal, Abuja.
Both motions, with di Independent National Electoral Commission and two others as respondents, don enter list for hearing on Friday (today).
Details later…
You fit go read di full tori…READ MORE