fbpx
December 23, 2024

Abia go seal banks wey dey hold State funds

abia-state-go-seal-banks-branches

Abia State Governor, Okezie Ikpeazu don give warning say hin administration go seal banks wey continue to withhold di State funds.

Di State government advise banks wey continue to place Post No Debit, PND, on Abia State accounts. Hin say make dem immediately resume financial transactions with di State or dem go seal dia branches for di State.

Also, inside statement signed by Barr Chris Ezem, di Secretary to di State government, Governor Ikpeazu yarn say an Abuja High Court wey bin freeze Abia State accounts, also vacate di same order.

FOR MORE NEWS: UK Immigration arrest: I no go ever break any law knowingly – Peter Obi

As Abia State Governor tok say hin go seal some banks branches, hin add say di banks no get reason to disobey di Abuja High Court.

“Government therefore directs all banks that have transactions with the Abia State government to resume normal transactions without further delay.” Na wetin hin tok.

In addition, hin add say say any bank wey failed to obey di vacation order go risk being sealed by di State government.

Di Governor equally warn individuals and groups against subjecting di State to litigations.

You fit go read di tori…READ MORE