fbpx
December 22, 2024

2023 Elections: Adeleke don meet security agencies, to call for peaceful polls

adeleke-meet-security-agencies

Osun State Governor, Senator Ademola Adeleke don call on residents make dem stay far from violence during di forthcoming general elections for Nigeria. Governor Adeleke give di advice as hin meet with di heads of security agencies on monday.

Remember say di sun All Progressives Congress, APC, on Wednesday for press conference criticize di state governor, Ademola Adeleke because hin fail to hold security meeting since hin inauguration for November, 2022.

Di governor, wey stress di tok say peaceful poll go deepen Nigeria democracy and enhance further realization of good governance, add say democracy no suppose mix with violence and di electorate suppose dey free to make dia choices.

“Democracy no need violence. Make everybody make dia choice peacefully. Your ballot na your power. Also, na your opportunity to decide who go govern your state and country.

FOR MORE NEWS: 2023: Wike, Ikpeazu go support Tinubu – Orji Kalu don make revelations

“Violence dey different from di spirit of democracy.

As Adeleke meet di security agencies, hin order dem make dem arrest and prosecute all identified thugs and criminals across the state.

Also, hin call on security agencies make dem ensure close cooperation and collaboration. Political campaigns dey enter di most critical stages and we must sustain di peace and security wey we dey enjoy” All this things na wetin Governor Adeleke tok.

As hin dey answer questions from journalists, Adeleke advise di residents make dem continue dia lawful businesses without fear or intimidation, because security agents dety on ground to protect di lives and property of all.

You fit go read di full tori…READ MORE