fbpx
September 29, 2024

2023 elections: “Think carefully” – Akinyemi dey tell Nigerians

akinyemi-advise-nigerians-ahead-of-elections

Prof. Bolaji Akinyemi, a former Minister of External Affairs, don advise Nigerians say make dem think carefully and vote according to dia conscience during di coming general elections for a better country.

Akinyemi give di advice for interview with di News Agency of Nigeria (NAN) during di Luncheon and Merit Awards ceremony to mark Igbobi College’s 91st Anniversary for di school wey dey Lagos on Sunday.

According to am, Nigerian citizens need to act in that kain manner because di young generation need a country wey go reward merit and hard work. Akinyemi yarn say e dey important make Nigerians think carefully as di general elections dey come.

He yarn say di country need “a round peg in a round hole”  wey no go only make di needed impact locally but also make sure say di country  dey for di rightful place internationally.

According to am, “this na because di world dey go through transition from di old order to di new, and e dey necessary for Nigeria to sit down for di table of decisions for di world.

“Nigeria seat no suppose dey empty for di world table where dem dey take decisions so that we go fit get active foreign policy for di betterment of di country,” Na wetin hin tok be that.

You fit go read di full tori…READ MORE