fbpx
September 30, 2024

Angry Nigerians don scatter POS vendor workplace over N4K charges on N10K cash withdrawal

angry-nigerians-scatter-pos-vendors-workplace

A group of angry Nigerians don pack dia sef go confront one POS vendor wey charge N4K on top N10K cash wey customer wan withdraw inside this scarcity of new Naira notes wahala.

POS vendor accosted by angry customers over N4K charges on N10K cash withdrawal (Video)

Di Naira note scarcity still continue following di redesign of Nigeria currency by di Central Bank of Nigeria (CBN). Also, di video wey dey make rounds on social media captured di moment wey angry Nigerians scatter POS vendor point over excessive charges.

While di girl wey dey do di pos business argue say di charges decision na order from her boss, di customers no gree hear that one. Also dem accuse di POS vendor say she dey greedy greedy and she dey squeeze money anyhow from her fellow Nigerians.

POS vendor accosted by angry customers over N4K charges on N10K cash withdrawal (Video)

However, pipo dey vexc, Dem scatter her workspace and those Nigerians blame her and her boss say na pipo like dem follow be part of di country problem.

FOR MORE NEWS: You lucky say I comot leave you – Tonto don react to di audio wey Churchill leak

See Nigerians reaction on di POS charges

@khris2pher noted, “I know say the country no good oh, but let’s try to help ourselves abeg. What’s this ffs?”

@AramideBillion write, Una wey dey justify this nonsense. I hope una dey aware say Emefiele don instruct say make dem dey arrested by EFCC/ICPC? This na criminal act.

@macheteros write, “This one sef go complain say na bcos dem buy the note na why. But shey you buy di notes 3800 for 10k sef? Haba! And she sef dey complain of Buhari say she want good government. Is alright.”

@babashinaayomi2 wrote, “Na wetin go end am laslas be this.,this is serious exploitation.,even if you got the money from graveyard doesn’t mean the charges should be that high.”

You fit go see di full gist…READ MORE