fbpx
December 22, 2024

Imo guber: My nomination dey divinely orchestrated – PDP Anyanwu

anyanwu-victory-for-imo-state

Senator Samuel Anyanwu, di National Secretary of di Peoples Democratic Party (PDP), don describe hin victory for di party Imo State governorship primary election as divinely orchestrated.

Anyanwu emerged as di PDP Governorship flagbearer during Wednesday’s primary election wey dem conduct for Owerri.

Hin garner  802 ‘yes votes’ cast during di election.

As hin follow newsmen tok at di end of di exercise, Anyanwu give assurance of hin total submission and commitment to di will of God.

Anyanwu encourage di party faithful and di pipo of Imo make dem “let God finish wetin hin don start.”

 

FOR MORE NEWS: Noboby suspended me from NNPP – Ebonyi guber candidate, Adol-awam

 

Also, Anyanwu yarn say na with humility and di greatest sense of responsibility hin accept hin divinely orchestrated nomination.” Na wetin Anyanwu tok be dat as hin describe hin victory as divinely orchestrated.

In addition, hin tell di pipo say hin go work with dem and for dem.

Finally, hin thank di Almighty God for hin infinite mercies and hin thank di leaders of dia party for Imo for working hard to set di process wey bring about hin emergence in motion.

Also, hin pledge to pursue an issue-based campaign wey go usher in a people-oriented government.

And, hin say Together, dem go achieve di Imo of dia dream.

You fit go read di tori…READ MORE