fbpx
December 22, 2024

Election petition: APC already dey plan for re-run – LP

apc-dey-prepare-for-re-run

Di National Chairman of di Labour Party, Mr Julius Abure on Monday yarn say hin get di information say di All Progressives Congress, APC dey already prepare for a possible re-run of di 2023 presidential election and dem encourage members of di party to stay alert.

Abure tok dis one during an online meeting wey dem hold with Nigerian-American Coalition for Justice and Democracy, led by Professor Eddie Oparaoji, di Labour Party Diaspora Chairman for di United States, for Abuja reports.

Hin explain say di ruling party dey aware say di tide don shift against am for di ongoing legal challenge to di presidential election results as declared by di Independent National Electoral Commission.

 

FOR MORE NEWS: Yul Edochie share video of himself and pregnant Judy Austin amidst divorce rumour with May

 

Acting National Publicity Secretary of di party, Obiora Ifoh, inside statement quote Abure say hin call on over 10 million members of di party to be “on alert and make dem dey ready to further humiliate APC and di government for polls if dia plot fail.”

Also, for his contribution to di discussion, di Director of di ObiDatti Presidential Campaign, Ambassador Oseloka Obaze, advise Obi-Datti members for di diaspora to see di struggle to recover di party mandate as a collective responsibility.

You fit go read di tori ss LP tok say APC dey Prepare for re-run…READ MORE