fbpx
September 30, 2024

2023 poll: APC El-Rufai, Ganduje, Badaru group dey against Buhari

apc-group-against-buhari

A week to di 2023 general elections, e clear say di ruling All Progressives Congress, APC, go enter di polls as a divided house, some APC group dey against Buhari.

President Muhammadu Buhari, wey be di leader of di party, dey for di centre of attacks by hin one time loyal and close friends.

Governors wey dey di party platform dey on di offensive against di President. Infact, some of them openly yarn say dem go disobey di President orders with regards to di Naira redesign policy.

Also, during national broadcast on Thursday, Buhari approve di restoration of di old N200 notes as legal tender. He, however, yarn say di February 10 deadline for di old N1000 and N500 notes still stand.

According to Buhari, “To further ease di supply pressures, particularly to our citizens, I don give approval to di CBN stay make dem release di old N200 bank notes back into circulation.

“And e go dey allowed to circulate as legal tender with di new N200, N500, and N1000 banknotes for 60 days from February 10, 2023 to April 10 2023 when di old N200 notes no go be legal tender.”

FOR MORE NEWS: Datti visit Obi of Onitsha, hin yarn say LP go win presidential election

But Governors on di platform of hin party, di APC no wan accept am, dem dey against Buhari

Dem dey insist say di policy dey designed by some elements’ inside di presidency, to stop di APC presidential candidate, Bola Tinubu from winning di presidential election.

Also, di governors wey dey lead di attack na Kaduna State Governor, Malam Nasir El-Rufai, Umar Abdullahi Ganduje of Kano State, and dia Jigawa counterpart, Badaru Abubakar.

El-Rufai and Ganduje dey claim say plan dey ground to stop di country democracy and to force military rule.

As e be so, dia claim no dey far from di allegations wey Femi Fani-Kayode make. Hin don become daily guest of di Department of State Services, DSS because of that matter.

Also, di military no waste time tok say dem no get plans to meddle into di country democratic process, and dem warn politicians say make dem mind wetin dey comot from dia mouth.

However, di President former close men dey voice out more attacks on hin administration.

El-Rufai address residents of hin State on Thursday evening. Hin tell them say make dem continue to dey use di old Naira notes. This na in total disobedience to di President earlier order.

El-rufai encouraged them say make dem stand up strongly for democracy, peace and national unity.

You fit go read more of di tori…READ MORE