fbpx
December 22, 2024

Group don demand arrest of interim government agitators

Group-call-for-protesters-arrest-wey-call-for-interim-government

Di South-West zone of di National Councilors Forum of Nigeria group don call for di arrest of protesters wey approach di Defence Headquarters to call on di military to take over governance for Nigeria.

Also, di group wey call for protesters arrest, condemn di pipo wey dey promoting unholy and uncivil activities for di country and wey dey furnish international community with mischievous representations of wetin happen during di just concluded general election.

For di press conference for Lagos on Thursday, di group call for action from di government to prevent further uncivil actions.

According to di group, dia believe be say if di government dey silent about di matter, plenty other uncivil actions go continue to happen in the nearest future.

FOR MORE NEWS: Timeless don becomes first-ever African album to hit no.1 on US iTunes album chart

On calls for interim government, di group yarn say e dey come from election losers wey “no get business for di much-needed democratic leadership of Nigeria.

In addition, di group yarn say “Interim government na illegality. Also, e dey unconstitutional. So na wetin make dem as legislators for di South-West reject dat kain requests. And dem wish say dia various state assemblies and National Assembly get a well-documented outright rejection of dat kain illegal requests.

Dem tok say dis development dey beyond politics, e don become matter of concern.

You fit go read di tori…READ MORE