fbpx
December 22, 2024

Accept defeat, retire go Dubai – Fayose dey mock Atiku

atiku-accept-defeat-fayose-don-tok

Former Governor of Ekiti State, Ayodele Fayose don advise di Presidential Candidate of di Peoples Democratic Party, PDP, Alhaji Atiku Abubakar make hin accept defeat. Dis na as di collation of Saturday presidential election still dey go on.

As hin appeal to Atiku make he show maturity accept di defeat, Fayose, wey belong to di same party as di Presidential Candidate, advise Atiku say make hin take break. He tell Atiku make hin retire go Dubai for di United Arab Emirates.

Di Ekiti ex-Governor tok dis one for inside tweet wey hin post on top hin verified Twitter handle on Monday evening.

FOR MORE NEWS: Presidential election result: Tension dey high, business activities don shutdown

Inside di tweet, hin write;

“Our candidate, H.E. Atiku Abubakar (aka ‘Atiku is coming’) need to accept defeat in maturity and retire peacefully go Dubai. At this juncture, make I say good night and good bye to all di thing wey you represent.”

Meanwhile, di Independent National Electoral Commission, INEC, neva announce di winner of di election. Di collation of Saturday elections still dey gon on.

Meanwhile, Atiku win some states for some of di results wey dem release. However, hin dey trail di candidate of di APC, Bola Ahmed Tinubu.

You fit go read di full tori…READ MORE