fbpx
December 22, 2024

Atiku win presidential election, no dey bully tribunal – PDP reply Buhari govt

PDP-insist-say-na-atiku-win-presidential-election

Di Peoples Democratic Party, PDP, don insist say na dia 2023 presidential candidate, Atiku Abubakar win di last election.

PDP National Publicity Secretary, Debo Ologunagba, yarn say results from polling units show say Atiku win di presidential election, but di Independent National Electoral Commission, INEC, announce di President-elect, Bola Tinubu as di winner of di election.

Ologunagba bin dey react to di remark of di Minister of Information and Culture, Lai Mohammed, on di opposition wey lose di 2023 presidential election.

 

FOR MORE NEWS: Presidential election: I go reclaim my mandate back – Peter Obi

 

Atiku and Labour Party Peter Obi lose di presidential election to Tinubu.

Both candidates dey before di presidential election tribunal to contest di outcome of di election.

But, Mohammed don charge di opposition say make dem stop dia endless matter over di last election because dem lose woefully.

Also, di minister yarn say President Muhammadu Buhari analysis on why di opposition lose di 2023 presidential election dey indisputable.

However, Ologunagba yarn say di thing wey Mohammed tok na to bully di Presidential Election Petition Tribunal.

You fit go read di tori as PDP yarn say na Atiku win last election…READ MORE