fbpx
December 22, 2024

Gov Bago don sack revenue contractor for Niger

bago-sack-revenue-consultants

Governor Umaru Bago of Niger State don direct di immediate sack of all revenue consultants and agents wey dey contracted by various Ministries, Agencies and Departments, MDAs, for di state.

According to NAN reports, di tori dey contained inside statement by Alhaji Abubakar Usman, di Secretary to di State Government, SSG, for  Minna on Thursday.

Also, hin yarn say di disengagement dey aimed at ensuring transparency, accountability and efficiency in revenue enforcement and collection for di state.

Bago yarn say di measure na part of di broader efforts by di present administration to ensure more organised and accountable revenue generation system wey go foster di sustainable economic growth for di state.

Also, di governor direct di affected organisations make dem return official vehicles and relevant documents wey dey dia hand to di permanent secretary or di most senior director for di respective MDAs with immediate effect.

You fit go read di tori, Bago sack revenue consultants…READ MORE